One day, David wake-up from sleep for aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round for der, e si one woman wey dey baf for en house and e fine well-well.
And na true sey, my oga know wetin I do wen Jezebel dey kill God profets. I hide hundred profets for two kave, fifty-fifty for each kave and I dey give dem wota and food.
So King Joram dota, Jehosheba, wey bi Ahazaya sista, eskape with Ahazaya pikin, so dem nor kill-am with di oda king shidren. Jehosheba keep di boy with en nurse for one room where dem dey keep tins inside di temple, so dat Atalaya nor go fit si and kill-am.
Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.
But Joshua nor kill Rahab wey bi ashawo, en family and evritin wey bilong to am. Rahab kon stay for Israel, bikos e hide di pipol wey Joshua send go spy Jeriko.