Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 2:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Den Rahab use rope take drop dem thru window. (Dem build Rahab house join di wall for di town and na der e dey stay.)

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 2:15
6 Iomraidhean Croise  

But one nite, di pipol wey dey follow Saul kon put am for basket, trow am down small-small from one small window wey dey near di town fence.


But awa pipol for der kon put mi for basket wey dem tie rope put kon drop mi small-small from di window and na so I take eskape from di man hand.


Di men kon tell am, “Wi swear with awa life sey, nor-tin go happen to yu! If yu nor tell anybody wetin wi kon do for here and God give us dis town, wi go sorry for yu and evritin wey bi yor own.”


Rahab tell dem, “Make una run go di kountry for di hill, so dat who dey porshu una nor go si una and make una stay der for three days. By dat time, pipol wey dey porshu una go don kom back, den una fit go una own.”


Wen di sojas hear di ram horn sound, dem kon shaut well-well for war. Di town wall fall rish groun and di sojas run enter di town at wons kon win Jeriko pipol.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan