Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 2:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Wen wi hear di news, fear katch us and wi kon dey tink sey wi go die wons wi si una. Bikos di Oga wey bi una God, na God for heaven, eart and evritin wey dey under di eart!

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 2:11
27 Iomraidhean Croise  

so dat all di nashons go know sey na only God bi God and e nor get anoda god.


Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”


Wen awa enemies wey dey di nashons wey surround us hear am, shame katch dem, bikos evribody know sey na God help us do di work.


For evry aria for di kingdom where dem for read di kommand, di Jew pipol for der go take holy day kon do party with happiness. In-short, many pipol kon turn to Jew, bikos dem dey fear di Jew dem naw.


Just as di nashons go fear wen dem si God, na so too kings go fall wen dem si en glory,


My life bi like wota wey dem trowey and all my bones don skata. My heart bi like kandol wey dey melt inside mi.


Make dem vanish like wota wey dey flow! Make dem dry like grass wey pipol go burn trowey!


Den dem go know sey na only Yu bi God, di Pesin wey get pawa pass for di whole world.


Oda kountries go hear wetin happen kon fear Yu; betta fear go hold Filistia pipol.


Den Edom leaders go fear well-well; di strong men for Moab go dey shake and di pawa wey Kanaan pipol get, go vanish.


So bikos of dis, evry hand go weak and evribody heart go fail am.


Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.


E dey make my pipol heart melt and doz wey go die go many well-well. My swod dey wait for all di gates, e dey shine well-well and e dey ready to kill.


Na wons dem tif and empty evritin for di town kon turn am to where dem dey trow dirty put. Dia heart melt and dia leg kon dey shake. Honga won kill pipol and pipol face don dey shange kolour!


Na wetin go happen to us? Awa own brodas don make us dey fear, bikos dem sey, ‘Di pipol wey dey di land big well-well pass us; dia kountry dey big and dem fence am rish heaven. Wi still si Anak shidren-shidren for der too.’ ”


Den di soja oga go sey, “E get anybody among us wey dey fear or en heart dey shake? If na so, yu fit go house before yu go make anoda pesin, fear too.”


So make una remember dis tins kon keep am well for una heart: Na di Oga God bi God, both for heaven and for eart and know oda god, dey.


Doz wey follow mi kon dey make Israel pipol fear, but I still dey loyal to di Oga my God.


Dem tell Joshua, “True-true, God don really give us di land, bikos evribody wey dey stay di land dey fear us well-well!”


Wen Amor pipol kings for Jordan River west and Kanaan kings wey dey near di wotaside for Jordan River hear how God take dry Jordan River for Israel pipol make dem waka pass, dem kon bigin fear well-well.


Ai men kill about thirty-six from dem kon porshu di rest of dem from di town gate go rish di low aria. Di pipol pawa fail dem like ice-blok wey dey melt.


Dem kon tell Joshua, “Wi do like dis, bikos wi hear sey na really true sey di Oga una God don kommand Moses make e give una di whole land kon kill all di pipol wey dey stay der as una rish der. Wi do like dis, bikos wi dey fear una and wi nor won die.


Dem kon dey kry give di mountin and di rock sey, “Make yu fall on-top us and hide us from di Pesin wey sidan for di throne and make yu hide us from di Lamb vexnashon.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan