“Naw, dis na di tribes name: From nort near Hetlon to Lebo-Hamat go rish Hazar-Enan (wey bi Damaskus boundary near di nort side for Hamat) wey wide from east go rish west. Dan tribe go get one part.
Joshua win di whole land plus di kountries for hill, for di Negev, di lowland, di slope and all dia kings. E nor let any one live. E kill evritin wey dey breath, just as di Oga wey bi Israel God, tok.
Dat time, Israel pipol nor get king. And Dan tribe dey find where dem go stay, bikos dem neva fit pak go di land wey dem divide give dem, wen dem dey divide land give all di tribe for Israel.