34 E from der turn face west for Aznot-Tabor till e rish Hukok kon tosh Zebulun for di sout. Asher dey for en west and Jordan River for en east.
Moses pray for Naftali tribe sey: “Naftali pipol, favor go follow una and God don bless una well-well; make una kollect di west and sout as una own.”
From Sarid, e turn face di east for Kislot-Tabor aria kon go Daberat and from der go Jafia.
Dia borda tosh Tabor, Shahazumah and Bet-Shemesh kon end for Jordan River. Dem get sixteen big and small town.
Dia borda start from Helef and Zaanannim oak kon go Adami-Nekeb, Jabneel until e rish Lakkum kon end for Jordan River.
Di strong towns na Ziddim, Zer, Hamat, Rakkat, Kinneret,