Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 19:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Dia borda tosh Tabor, Shahazumah and Bet-Shemesh kon end for Jordan River. Dem get sixteen big and small town.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 19:22
14 Iomraidhean Croise  

Ben-Deka dey kare for Makas, Shaalbim, Bet-Shemesh, Elon and Bet-Hanan town.


Dem give Gershom shidren-shidren, thirteen towns for Issakar, Asher, Naftali and East Manasseh wey dey for Bashan aria.


Di remainin family wey dey Merari tribe, na di land wey dem give dem bi dis: For Zebulun aria, dem give dem: Rimmono and Tabor.


Na Yu kreate di nort and sout. Mount Tabor and Mount Hermon dey praiz yor name.


Mi, God wey dey mighty, I bi king. Na mi bi di God wey dey alive. As Mount Tabor high pass di mountins and Mount Karmel high pass di sea, di enemies wey dey kom attack una, na so dia pawa bi.


From Sarid, e turn face di east for Kislot-Tabor aria kon go Daberat and from der go Jafia.


Remet, En-Gannim, En-Haddah and Bet-Pazez.


All dis na di land wey dem give Issakar tribe and dia family, plus di big and small town.


Yiron, Migdal-El, Horem, Bet-Anat and Bet-Shemesh. Dem get nineteen big and small town.


Ain, Juttah and Bet-Shemesh, plus all di aria for der.


Wen dem tell Sisera sey, Barak, Abinoam pikin don go Mount Tabor,


One day, e send message go koll Barak, Abinoam pikin, wey dey stay for Kedesh for Naftali land kon tell am, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God kommand sey make yu do: Make yu koll 10,000 wariors from Naftali and Zebulun tribe go Mount Tabor.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan