One day, Elisha go Shunem, where one woman wey get money dey stay. Di woman kon sey make Elisha kom chop for en house, so wen ever Profet Elisha dey go Shunem, e go stop chop for der.
King Joram go back to Jezrel go trit ensef bikos of di wounds wey Siria sojas giv-am, wen e fight King Hazael. So King Ahazaya, Joram pikin kon go visit am.
Josef shidren ansa, “All di kountries for di hill nor good rish for us and Kanaan pipol wey dey stay di valley for Bet-Shean and di towns and Jezrel Valley get shariot wey get pawa well-well.”