Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.
But Levi pipol nor go get any land among una, bikos dia propaty na to serve God. Gad, Reuben and half for Manasseh tribe don already take dia part for Jordan River east wey Moses give dem.”
Wen di men kom out, Joshua kon tell doz wey dey go look di land sey, “Make una go waka round di land kon put am for map, den una go kom back kom meet mi, so dat I go trow dice for una for God present as wi dey Shiloh.”