Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 18:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 Zela, Haelef, Jebus pipol town (wey bi Jerusalem), Gibeah and Kiriat. Dem bi fourteen big and small town. All dis na di land wey Joshua give Benjamin tribe.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 18:28
22 Iomraidhean Croise  

den e beri Saul and Jonatan bones for Saul papa, Kish, grave for Zela wey dey Benjamin aria and di pipol do evritin wey di king kommand. Afta evritin wey dem do, God kon ansa Israel pipol prayer.


Heled wey bi Baanah pikin wey kom from Netofat; Ittai wey bi Ribai pikin wey kom from Gibeah for Benjamin tribe;


Time kon rish for David and en men to attack Jerusalem. Jebus pipol wey dey der, tink sey David nor go fit win di town. So dem tell David, “Yu nor go fit enter here, even blind pipol and cripple, go fit win yu.”


David ask en men dat day, “E get anybody for here wey hate Jebus pipol rish mi? Make wi kill dem? Den, make una pass di wota go kill doz poor and blind cripple.” Na dis make dem sey, “Doz wey dey blind and cripple, nor fit enter God house.”


All dis na di leaders for di family with dia shidren-shidren for Jerusalem just as dem rekord am.


den dem cross kon go sleep for Gibeah dat nite! Pipol for Rama town dey fear and di pipol wey dey for Saul village for Gibeah, don run komot der.


Benjamin pipol, make una run for una life! Make una run komot from Jerusalem! Make una blow trumpet for Tekoa kon put sign for Bet-Hakkerem, bikos wahala and distroshon dey kom from nort.


Oga God sey, “Israel pipol, na since una dey Gibeah una dey sin kom rish naw and una nor dey progress at-all. Una nor si as dem kill Gibeah wiked pipol for war?


Benjamin shidren akordin to dia family na: Bela family; Ashbel family; Ahiram family;


Any tribe wey plenty, yu go give dem big land and di tribe wey small, yu go give dem small land. Yu go give evry tribe akordin to dia nomba.


Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.


Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.


E from der go Ben-Hinnom Valley go rish di lowland for Jebus for sout (wey bi Jerusalem) and from der, e go on-top di hill opposite Ben-Hinnom Valley for west wey dey di end for Refah Valley for nort.


Di borda go di hill kountry near Ben-Hinnom Valley wey dey Refah Valley for nort. E from Hinnom Valley go di low land for Jebus aria for sout, den kon go En-Rogel.


Rekem, Irpeel, Taralah,


Di sekond koin wey Joshua trow na for Simeon tribe and family.


Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.


But dis time, di man don make up en mind to go. So e take en two donkey and en girl-friend kon pass thru Jebus (wey bi Jerusalem).


Even Saul sef go en house for Gibeah. But some strong men wey God don tosh dia heart, follow am go en house for Gibeah.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan