Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 18:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 For der, Joshua kon trow dice for God present kon divide di land among Israel pipol just as e suppose to bi.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 18:10
24 Iomraidhean Croise  

As e bi sey di temple ofisas and spiritual leaders dey among Eleazar and Itama shidren-shidren, dem kon trow dice take divide dem.


Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before.


E choose and give us di Promise Land as awa propaty for life; di place wey dey make Jakob shidren-shidren happy; di shidren wey God love.


Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.


If men wey get pawa dey tok against each oda for kourt, to trow dice fit solve di matter.


Make una go Shiloh, di place wey I first choose sey dem go for dey woship mi. Make una si wetin I do for der bikos of di wiked tins wey my pipol Israel, do.


Di strenjas wey dey among una and di ones wey born dia shidren for here, go still kollect dia own share wen una dey divide di land. Una go trit dem as una dey trit Israel pipol and dem go trow dice for each land wey go bi any tribe for Israel own.


Dis na di share for di land wey yu go give Israel tribes and e go bi dia own. God wey get pawa don tok.”


So wen di time rish to divide land for God pipol, dem nor go give una any part.


Wen dem don nail am for cross, dem kon gambol take divide en klot.


Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.


Afta E don distroy seven tribes for Kanaan, E kon dash en pipol di land.


yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’


Make una dey tank God, bikos E don make una share from wetin en pipol get for en kingdom wey dey give lite.


Di land wey dem give di nine and half tribe, na dice dem trow take divide am, just as God tell Moses.


Wen dem dey divide di land, Israel pipol do as God tell Moses.


Di first dice wey Joshua trow na for Benjamin tribe akordin to dia family. Dia land na between Judah and Josef tribe.


But as for una, make una divide di land into seven, den bring am kom meet mi. I go trow dice before di Oga awa God.


Wen di men kom out, Joshua kon tell doz wey dey go look di land sey, “Make una go waka round di land kon put am for map, den una go kom back kom meet mi, so dat I go trow dice for una for God present as wi dey Shiloh.”


Di men waka round di land kon divide am into seven for di book. Den dem kom back kom meet Joshua for di kamp for Shiloh.


Eleazar di priest, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders, na dis bi di whole land wey dem divide and dem rite am for book kon put am for Shiloh for God present. So, dem kon divide di land finish.


Di nashons wey still remain, I don give dia land to una tribe, from Jordan River go rish Mediterranean Sea for west, plus all di nashons wey I win.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan