King Jeroboam for Israel, guide and build wall round Shekem town, wey dey di hill kountry for Efraim kon stay der for sometaim. Den e komot for der kon go build and guide Penuel town.
So dem selet Kedesh for Galilee wey dey Naftali kountry on-top di hill; Shekem wey dey Efraim kountry on-top di hill and Kiriat-Arba (wey bi Hebron) wey dey Judah kountry for hill.
Josef bone wey dem karry kom from Egypt, Israel pipol kon beri am for Shekem, for part of di field wey Jakob buy from Hamor sons (Na Hamor bi Shekem papa) and Jakob buy di field for one hundred silva koin.