di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”
Josef shidren ansa, “All di kountries for di hill nor good rish for us and Kanaan pipol wey dey stay di valley for Bet-Shean and di towns and Jezrel Valley get shariot wey get pawa well-well.”
Di whole kountry for di hill go bi una own; even doh na forest, una fit klear and take am. Una fit distroy Kanaan pipol for der, aldo dem get strong shariot well-well.”
E get one man wey kom from Ramataim Zofim for Efraim kountry wey dey on-top hill and en name na Elkanah. Elkanah papa name na Jeroham. Elihu wey bi Tohu pikin, na-im born Jeroham and na Zuf wey kom from Efraim tribe, bi Tohu papa.