Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 17:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Josef shidren ansa, “All di kountries for di hill nor good rish for us and Kanaan pipol wey dey stay di valley for Bet-Shean and di towns and Jezrel Valley get shariot wey get pawa well-well.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 17:16
20 Iomraidhean Croise  

So dark kloud kon kover di sky; di wind blow and heavy rain bigin fall. King Ahab ride dey go Jezrel.


Naw God give Elijah pawa, so e tie en rope round en waist kon run with leg pass Ahab go Jezrel.


E get one vineyard wey dey near King Ahab palis for Jezrel and na Nabot get am.


“And for Jezebel yor wife, God sey, ‘Na dogs go chop en body for Jezrel town.’


Baana wey Ahilud born, dey kare for Taanak, Megiddo and all di aria for Bet-Shean near Zaretan town, for di sout-side for Jezrel town go rish Abel-Meholah and Jokmeam town.


Dogs go chop Jezebel for Jezrel land and nobody go beri am.’ ” Den di yong profet kon kwik-kwik komot der.


Wetin remain for Jezebel body, go skata like dirty for Jezrel land and pipol nor go fit know am at-all.’ ”


But di time dey kom wen I go make Rabbah pipol hear war nois, den dem go distroy and burn dia village rish groun. Den Israel pipol go take dia land back from doz wey take am from dem.


Jezrel, Jokdeam, Zanoah,


Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.


Joshua ansa dem, “If una many well-well and di kountries for hill too small for una, den make una go inside di forest kon klear Periz and Refah land for unasef.”


Joshua kon tell Josef family wey bi Efraim and Manasseh sey: “Una get many pipol and betta sojas wey get pawa. Una go get pass one share.


Di whole kountry for di hill go bi una own; even doh na forest, una fit klear and take am. Una fit distroy Kanaan pipol for der, aldo dem get strong shariot well-well.”


Dia land na Jezrel, Kesullot, Shunem,


God dey with Judah pipol, so dem take di hill kountry. But dem nor fit drive di pipol wey dey di koast aria komot, bikos di pipol shariot, bi like iron.


e koll en 900 iron war horse and en men, den dem mash komot from Haroshet-Haggoyim go Kishon River.


Sisera, get 900 iron war horse and e opress and rule Israel pipol with wikedness for twenty years, before Israel pipol kon kry give God make E help dem.


Leta, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert gada togeda kon cross Jordan River go kamp for Jezrel Valley.


Filistia pipol gada dia sojas for Afek, while Israel pipol kamp for Jezrel wotaside.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan