13 So Israel pipol pawa kon strong well-well pass Kanaan pipol own for dat aria, so dem kon force Kanaan pipol to bi dia slave, but dem nor fit win dem finish.
Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.
But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.
Zebulun tribe nor fit drive di pipol wey dey Kitron and Nahalol, so Kanaan pipol still dey stay among dem. But dem force and turn Kanaan pipol to dia slave.
Na so too, Naftali tribe nor fit drive Bet-Shemesh and Bet-Anat pipol komot, instead, dem dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land. Dem force di pipol to work for dem as dia slave.
Amor pipol still dey stay for Mount Heres, Aijalon and Shaalbim, but wen Josef shidren-shidren don strong well-well, dem kon force Amor pipol to work as dia slave.