12 But di men for Manasseh nor fit win dis towns and Kanaan pipol still dey di aria with dem.
Doz wey kom from Ammon, Het, Periz, Hiv and Jebus dey too and dia shidren still bi slaves for Israel till today.
Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.
Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.