Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 17:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 17:11
22 Iomraidhean Croise  

e kon go kollect Saul and Jonatan en pikin bones from Jabesh pipol for Gilead. (Dem bin karry dem form Bet-Shan for where dem hang dem put afta Filistia pipol kill Saul for Mount Gilboa.)


Solomon force some pipol build di temple, di palis and e fill di land for di east side kon build di town wall. E still use dem take ribuild Hazor, Megiddo and Geza town.


Wen King Ahazaya for Judah si wetin happen, e kon run face Bet-Haggan. Jehu porshu am kon sey, “Make una kill-am too.” Dem shot am as e dey drive dey go Gur near Ibleam. But e still manage run until e rish Megiddo for where e for die.


For West Manasseh aria, dem give dem Aner and Bileam towns with all dia land.


Na Manasseh shidren-shidren dey kontrol Bet-Shean, Taanak, Megiddo, Dor and di oda towns wey dey near dem. Josef wey bi Jakob pikin, na en shidren-shidren stay all dis towns.


But King Josaya nor hear word, bikos e don ready ensef for war. E nor listin to wetin King Neko tok at-all, so e kon go fight am for Megiddo Hill.


Dem die for Endor and dia body kon make di grass grow well.


But di time dey kom wen I go make Rabbah pipol hear war nois, den dem go distroy and burn dia village rish groun. Den Israel pipol go take dia land back from doz wey take am from dem.


For dat time, di kry for Jerusalem go heavy pass Hadad-Rimmon wey dey near Megiddo own.


and all di kings for nort wey dey rule di kountries for hill, di Arabah for di sout for Kinneret, di ones for di lowland and doz ones for Dor wey dey di west,


Taanak king, Megiddo king,


Dor king (for Nafat Dor), Goyim king (for Gilgal) and


Di big and small towns wey dem keep for Efraim family inside Manasseh aria dey join.


Efraim aria na for sout, while Manasseh own na for nort. Di sea na Manasseh borda for west and dia aria tosh Asher for nort and Issakar for east.


Josef shidren ansa, “All di kountries for di hill nor good rish for us and Kanaan pipol wey dey stay di valley for Bet-Shean and di towns and Jezrel Valley get shariot wey get pawa well-well.”


Manasseh pipol nor fit drive di pipol for Bet-Shean, Taanak, Dor, Ibleam, Megiddo and doz wey dey near der. So doz pipol still dey stay der.


Kanaan kings kom fight for Taanak near Megiddo wota, but dem nor take any silva komot der.


So Saul kommand en savants, “Make una go find any woman wey dey do majik kom, so dat I go-go ask am wetin go happen.” En savant ansa, “E get one majik woman for Endor.”


Dem put Saul swod for Ashtoret temple kon hang en body for Bet-Shan wey bi di town wall.


all dia sojas kon travel for nite go der. Dem karry Saul and en sons dead body from di town wall kon go back to Jabesh where dem for beri dem.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan