1 Josef first-born, Manasseh, dem give en tribe some land too. Manasseh first-born Makir wey bi Gilead papa, dem gi-am land, bikos dem bi wariors. Dem give dem Gilead and Bashan.
Den di dotas wey Zelofehad wey Hefa born, wey Gilead born, wey Makir born, wey Manasseh born wey Josef born kon kom. Di girls names na, Mahlah, Noah, Hoglah, Milka and Tirzah.
So Moses give Gad, Reuben and half for Josef first-born Manasseh tribe, all di aria wey bi Amor king, Sihon own and e still give dem king Og for Bashan own, plus di towns and kountries wey dey round dem.
E must give di first pikin wetin bi en own, even doh e nor love di mama. E must gi-am times two of wetin e give di sekond pikin, bikos na di first son bi en papa pawa and honor.
Di rest for Manasseh shidren, dem give dem land akordin to dia family plus Abiezer, Helek, Asriel, Shekem, Hefa and Shemida shidren. Dis na di boys wey Manasseh, Josef pikin born akordin to dia family.
(Naw, Moses give Bashan land to half of Manasseh tribe and Joshua kon give Jordan River west to di oda half for Manasseh tribe and Israel pipol wey dey with dem.) Wen Joshua sey make dem dey go house, e give dem gift
Dem from Efraim go di valley, di land wey bi Amalek pipol own before and dem follow Benjamin tribe with en men. Di kommanders kom from Makir and di ofisas kom from Zebulun.