4 Dem give Josef shidren, Manasseh and Efraim dia own part for di land.
E koll di sekond boy, Efraim bikos e sey, “True-true, for di land where I for dey sofa, God don make mi fruitful.”
God wey get pawa sey, “Dis na di land wey yu go divide among di twelf tribes for Israel. But Josef tribe go get two.
Dem si Josef shidren as two tribe, Manasseh and Efraim. Dem nor give Levi pipol any land; aldo dem give dem towns where dem go stay, plus fields where dia animals go for dey chop.
Di aria wey dem give Efraim and en family na: di east for Atarot-Addar go rish top of Bet-Horon.
Josef shidren kon tell Joshua, “Wetin make yu give us only one part for di land? Wi many well-well, bikos God don bless us.”
Den I go divide am into seven. Judah go stay for di sout-side and Josef family go dey nort.