10 Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.
Solomon force some pipol build di temple, di palis and e fill di land for di east side kon build di town wall. E still use dem take ribuild Hazor, Megiddo and Geza town.
Na Egypt king attack and kapture Geza before. E kill all Geza pipol kon burn di town. But wen en pikin won marry Solomon, e kon gi-am to di girl as marriage gift.
Dia shidren-shidren still dey di land (Israel pipol nor fit porshu all of dem komot from di land). So, Solomon kon use dem take dey do en work and na savant dem bi till today.
So Israel pipol pawa kon strong well-well pass Kanaan pipol own for dat aria, so dem kon force Kanaan pipol to bi dia slave, but dem nor fit win dem finish.