Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 15:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 E from der go Ben-Hinnom Valley go rish di lowland for Jebus for sout (wey bi Jerusalem) and from der, e go on-top di hill opposite Ben-Hinnom Valley for west wey dey di end for Refah Valley for nort.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 15:8
17 Iomraidhean Croise  

Filistia pipol kamp for Refah Valley.


Filistia pipol kon go Refah Valley go stay again.


Di king skata Tofet for Ben-Hinnom Valley, so dat nobody go fit sakrifice en pikin for Molek juju again.


David and Israel pipol go attack Jerusalem. Dat time, dem dey koll Jerusalem, “Jebus”, bikos na Jebus pipol dey stay di land.


E use en sons take do sakrifice for Ben-Hinnom Valley and na dis kind sins di nashons wey dey der before, dey do wey make God drive dem komot di land.


Zanoah and Adullam with di village wey dey der. Dem still dey Lakish with di field wey dey near der and Azeka with en village. So Judah pipol stay from Beersheba go di sout valley for Ben-Hinnom.


E go bi like wen pesin gada rice kon blow di kanda trowey. Just like wen pesin dey blow kanda komot from rice for Refah Valley.


Den, Jeremaya komot from Tofet where God for tok to mi kon go stand for di kourt wey dey di temple front, den tell all di pipol wetin


Make una pass Potsherd Gate go Ben-Hinnom Valley. Den yu go tell dem wetin I tell yu, for der.


So mi wey bi God dey sey, “Time dey kom wen pipol nor go koll dis place Tofet or Ben-Hinnom Valley again, but dem go dey koll am, di Valley Where Dem For Dey Kill Pipol!”


Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.


Di borda go di hill kountry near Ben-Hinnom Valley wey dey Refah Valley for nort. E from Hinnom Valley go di low land for Jebus aria for sout, den kon go En-Rogel.


Zela, Haelef, Jebus pipol town (wey bi Jerusalem), Gibeah and Kiriat. Dem bi fourteen big and small town. All dis na di land wey Joshua give Benjamin tribe.


Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.


Den Judah men attack and seize Jerusalem; dem kill all di pipol kon burn di town rish groun.


But dis time, di man don make up en mind to go. So e take en two donkey and en girl-friend kon pass thru Jebus (wey bi Jerusalem).


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan