E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.
Di desert go sing and shaut bikos e dey happy; e go fine like Lebanon mountins. Di soil go dey good like Sharon and Karmel farms. Evribody go si God glory, en greatness and pawa.
Den Samuel stand up wen day neva break well-well kon go meet Saul. But dem tell Samuel sey, “Saul don go Karmel where e dey build image for ensef. Den Samuel go Gilgal.”
Saul and en men kon go look for David. But dem tell David, so e kon go stay di rock for Maon desert. Wen Saul hear sey e dey der, e kon porshu David go Maon desert.
E get one man for Maon and e dey sell for Karmel town. Dis man get money well-well; e get 3,000 sheep and 1,000 goats. Dat time, e dey barb en sheep hair for Karmel.