God go divide Egypt pipol sea; E go wave en hand pass Eufrates River kon send one strong breeze, den E go turn am to seven small river wey don dry kon make pipol dey waka pass with ordinary leg.
Di boundary for east na from sout between Damaskus and Hauran with Jordan River wey bi boundary between Israel land for west and Gilead for east go rish Tamar for di Dead Sea.
E tell mi, “Dis wota dey flow go di east, den from der go Jordan River Valley kon enter di Dead Sea. Afta di wota don flow go di Dead Sea wey get salt taste, di sea go kon turn to fresh wota.
di wota wey dey rush, just stop. E gada go up for one town wey dem dey koll Adam (Adam dey near Zaretan) and no wota rush kom from der again go rish Arabah Sea (Di Salt Sea). Di pipol cross di river wey face Jeriko.