Di men for Israel kon sey, “Yu si dis man wey dey kom out always? E dey do like dis to shalenge all Israel. But awa king don sey, ‘Anybody wey go fit kill di man, e go gi-am money and en dota make e marry and di pesin papa house nor go dey pay tax again.’ ”