12 Na Mediterranean Sea bi di borda for west. And na dis bi di borda for Judah tribe and family.
Di west boundary na from Mediterranean Sea go rish di nort side for west wey bi Hamat Pass.
For Reuben boundary for east go rish west, Judah tribe go get one part.
Anywhere wey una waka rish, dat land go bi una own. Una land go long and wide from di wildaness go Lebanon and from River Eufrates go rish Mediterranean Sea.
E still from der go Ekron lowland for nort till e rish Shikkeron, den cross go Mount Baalah, till e rish Jabneel kon end for di sea.
Ashdod and doz wey dey near am, plus Gaza with doz wey dey near am, go rish Egypt Stream and di borda for Mediterranean Sea.
Den I go divide am into seven. Judah go stay for di sout-side and Josef family go dey nort.