“Wen dem don divide di land kon give all di tribes for Israel dia share, dem go dedikate one part give God. E go almost long rish nine mile kon wide pass three mile. All dis aria go dey holy.
But Moses nor divide land give Levi pipol as e bi sey dia propaty na di sakrifice ofrin, wey dem dey offa give di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.
Di oda half of Manasseh tribe, Reuben tribe and Gad tribe don kollect dia land wey dey di oda side for Jordan River, just as God savant Moses divide am.