Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 14:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Yet, I still strong like wen Moses send mi go spy. I fit still fight kon do my evriday work with di same pawa wey I get dat time.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 14:11
7 Iomraidhean Croise  

E satisfy awa life with good tins and even as wi still dey yong, awa life strong like eagle own.


Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.


But pipol wey dey wait for God to kom help dem go get new strent and pawa. Dem go fly high like eagle; even wen dem run, dem nor go taya and wen dem waka, dem nor go faint.


“I don rish one hundred and twenty years naw and I nor go fit still bi una leader again. God don tell mi sey, ‘Yu nor go follow dem cross Jordan River.’


Una gate key go bi iron and bronze and God go guide una forever.


Moses na one hundred and twenty years wen e die, but en eye still klear and e still strong like yong boy.


“So naw, make yu si, God don keep mi rish naw, just as E promise. For dis forty-five years, even since God tell Moses en word wen Israel pipol still dey di wildaness kom rish naw, I nor die and naw, I bi eighty-five years.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan