Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 13:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Dia own aria go start from Aroer (wey dey near Arnon Valley), plus di town wey dey di valley centre; evriwhere for Medeba go rish Dibon

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 13:9
15 Iomraidhean Croise  

Dem cross Jordan River go kamp for di sout-side for Aroer land, di town for di valley wey dey Gad aria centre. From der, dem go di nort side for Jazer and


Di 32,000 shariot wey dem hire and Maaka sojas kon kamp near Medeba. All Ammon pipol ready kom from dia town to fight.


But for di village around dia fields, some among di pipol for Judah dey stay Kiriat-Arba, Dibon and Jekabzeel with di place and village wey dey der.


Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.


Yu wey dey stay for Dibon, kom down from yor place where honor dey kon sidan for san-san; bikos di pesin wey distroy Moab and skata en strong-strong buildings, go distroy una too.


Dibon, Nebo, Bet-Diblataim,


Doz wey dey distroy go distroy evry town. E nor get any town wey go eskape. Dem go distroy di town dem wey dey di valley with doz ones wey dey di hill too. Mi, wey bi God, don tok.


Wi don ova pawa dem; from Heshbon go rish Dibon and all dia pipol don die finish. Wi don skata dem go rish Nofah wey dey near Medeba.”


From Aroer wey dey River Arnon korna (River town), go rish Gilead, e nor get any town wey fit fight us. Di Oga awa God give us all doz towns.


Dis na di land wey wi kollect den: Di aria from Aroer go River Arnon and half for Gilead hill kountries with dia towns, I give dem to Reuben and Gad tribe.


Di aria from Gilead go rish River Arnon (Di main centre) go rish River Jabbok, wey dey Ammon pipol borda, I still give dem to Reuben and Gad tribe.


King Sihon for Amor wey dey stay Heshbon and dey rule from Aroer (wey dey Arnon Valley korna), plus di town wey dey di valley centre and half of Gilead go rish Jabbok Valley wey dey near Ammon.


and all di town wey Sihon king for Amor wey dey rule Heshbon get, go rish di borda.


Dia aria start from Aroer (wey dey near Arnon Valley) plus di town wey dey di valley centre, evriwhere for Medeba,


Di oda half of Manasseh tribe, Reuben tribe and Gad tribe don kollect dia land wey dey di oda side for Jordan River, just as God savant Moses divide am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan