Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 13:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 “I go porshu di pipol wey dey doz land komot for my pipol, Israel. All of dem wey dey stay di hill kountries from Lebanon go rish Misrefot-Maim, plus Sidon pipol, I go distroy dem, den yu go give dia land to Israel pipol, just as I tok.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 13:6
13 Iomraidhean Croise  

Yu take us from Egypt like grape fruit, den Yu porshu di wiked nashons kon give us dia land.


Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.


“Make yu dey strong and get heart! Yu go lead dis pipol go win di land wey I don promise dia grand-grand papa sey, I go give dem.


Joshua enter all di royal towns kon kill dia kings, just as God savant, Moses kommand dem.


God give dem to Israel and en pipol kill and porshu dem go rish Greata Sidon, Misrefot-Maim and Mizpa Valley for di east. Dem kill all of dem finish.


Naw, make yu divide dis land among di nine and half tribes.”


den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una.


Di nashons wey still remain, I don give dia land to una tribe, from Jordan River go rish Mediterranean Sea for west, plus all di nashons wey I win.


Di Oga una God go drive dem komot for una, so dat una go fit stay dia land just as di Oga una God promise una.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan