Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.
Joshua win di whole land plus di kountries for hill, for di Negev, di lowland, di slope and all dia kings. E nor let any one live. E kill evritin wey dey breath, just as di Oga wey bi Israel God, tok.
Kanaan pipol from di east and west; Amor, Hit, Periz and Jebus pipol from di kountry for hill and Hiv pipol from under Hermon for di aria wey dey Mizpa.