Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 13:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Di land wey dem give half of Makir shidren wey Manasseh bi dia grand-grand papa na: half for Gilead land, Ashtarot and Edrei and King Og for Bashan kingdom and na akordin to dia family.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 13:31
14 Iomraidhean Croise  

Dis na di land and field wey dem give Gershom tribe: For East Manasseh aria, dem give dem: Golan for Bashan and Ashtarot.


Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings.


From Naftali boundary for east go rish west, Manasseh tribe go get one part.


E win King Og for Bashan wey dey among di remainin Refah pipol and e dey stay for Ashtarot and Edrei.


And all King Og aria for Bashan, wey dey rule Ashtarot and Edrei (wey dey among di remainin pipol for Refah), go bi dia own too. Moses win dem kon take dia land.


Na so Moses sey make dem take divide di land wen e dey Moab for Jordan River east opposite Jeriko.


Dem give Manasseh ten share for di land join di ones wey e get for Gilead and Bashan wey dey Jordan River east


and dem give Manasseh dotas some land among dia brodas. Di rest for Manasseh shidren, na dem get di lands for Gilead.


and di ones wey E do to di two Amor pipol king for di oda side for Jordan River and dem bi King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan wey dey Ashtarot.


Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.


Gilead pipol dey for Jordan River east, while Dan pipol dey near di sheep. Asher pipol nor gri komot from di wotaside, dem dey stay near di river.


Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’


Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan