14 But Moses nor divide land give Levi pipol as e bi sey dia propaty na di sakrifice ofrin, wey dem dey offa give di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.
For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).
But Levi pipol nor go get any land among una, bikos dia propaty na to serve God. Gad, Reuben and half for Manasseh tribe don already take dia part for Jordan River east wey Moses give dem.”