10 and all di town wey Sihon king for Amor wey dey rule Heshbon get, go rish di borda.
Dis tin happen for Edrei, afta dem win King Sihon for Amor, wey en soja oga na Heshbon and King Og for Bashan wey en sojas oga na Ashtarot.
But wen una don near Ammon pipol, make una nor let dem vex won kon fight una, bikos I nor go give una any of dia land; bikos I don already gi-am to Lot shidren-shidren.
Dia aria na Gilead, Geshur and Maakat, plus evriwhere for Mount Hermon and Bashan go rish Salekah.
Dia own aria go start from Aroer (wey dey near Arnon Valley), plus di town wey dey di valley centre; evriwhere for Medeba go rish Dibon