Gibeah wey Uri born, naim dey kare for Gilead wey King Sihon from Amor and King Og for Bashan bin dey rule. Apart from dis twelf, e still get one govnor wey dey rule di whole land.
“If Gad and Reuben pipol cross Jordan River go fight akordin to God kommand and if una konker di land with dia help, den una go give dem dis land as dia propaty.
So Moses give Gad, Reuben and half for Josef first-born Manasseh tribe, all di aria wey bi Amor king, Sihon own and e still give dem king Og for Bashan own, plus di towns and kountries wey dey round dem.
But Levi pipol nor go get any land among una, bikos dia propaty na to serve God. Gad, Reuben and half for Manasseh tribe don already take dia part for Jordan River east wey Moses give dem.”
Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.