Dem go distroy di town kon skata evriwhere! So make una listin, all di far-far land for di eart. Make una dey ready to fight, but dem go still distroy una!
God tell Joshua, “Make yu nor fear dem, bikos by dis time tumoro, I go distroy dem for Israel pipol front. Yu must cripple all dia horse kon burn dia shariot.”
Na dem bi demon spirit wey dey do mirakle. Na dem dey go gada all di kings wey dey for di world, so dat dem go fight di fight wey go happen for di day wey God Almighty go judge di world.