Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 11:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 All dis kings kom out with dia sojas and nobody fit kount dem, bikos dem many like san-san for wotaside and dia shariot many well-well too.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 11:4
8 Iomraidhean Croise  

I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.


Yu bin sey, ‘I go really do good for yu kon make yor shidren plenty like san-san wey nobody fit kount.’ ”


“I dey advise yu sey make yu bring all Israel pipol togeda, even doh dem many like san for wotaside kon skata for evriwhere for di kountry. Make yu yorsef lead dem go di war.


Israel and Judah pipol plenty like san-san for wotaside; dem get enough food to chop and drink and dem dey happy.


Doz nashon go fall skata for groun, but wi go raiz kon stand gidigba for groun.


All dis kings gada for Merom River side, bikos dem won fight Israel pipol.


Midian and Amalek pipol and di men wey dey stay di desert, many for di valley like worm and dia kamel many like san-san for wotaside.


Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan