Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 11:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own. Den di land kon get peace and di war kon stop.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 11:23
20 Iomraidhean Croise  

Dem win Kanaan land; Yu ova-take di pipol wey dey stay der. Yu give yor pipol pawa to do anytin wey dem like with Kanaan pipol and kings.


E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear, den E burn di shield with fire.


Make yu obey wetin I dey kommand yu today. I go drive Amor, Kanaan, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot for una.


Dis aria go bi di prince wey dey rule Israel own, so e nor go opress di pipol again and di remainin part for Israel go bi di tribes own.”


But na Nun pikin Joshua wey dey assist yu go enter. So make Yu enkourage am, bikos na en go lead Israel pipol enter di land.


So wen di Oga una God don give una rest from all una enemies for di land wey E promise una, una must distroy Amalek pipol finish for dis world and nor of dem go remain.


Joshua fight against dis kings for sometaim.


Dis na di kings wey Joshua and Israel pipol win for Jordan River west, from Baal-Gad for Lebanon Valley go rish Mount Halak and Seir. Joshua give dis aria to Israel tribes,


For der, Joshua kon trow dice for God present kon divide di land among Israel pipol just as e suppose to bi.


Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.


E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan