2 and all di kings for nort wey dey rule di kountries for hill, di Arabah for di sout for Kinneret, di ones for di lowland and doz ones for Dor wey dey di west,
King Ben-Hadad agri with wetin King Asa tok and e send en soja kommander make dem go attack Israel town. Dem attack and katch Ijon, Dan, Abel-Bet Maaka; di arias near Galilee wotaside and evriwhere for Naftali.
Joshua win di whole land plus di kountries for hill, for di Negev, di lowland, di slope and all dia kings. E nor let any one live. E kill evritin wey dey breath, just as di Oga wey bi Israel God, tok.
Di men for Gibeon kon send message go meet Joshua for en kamp for Gilgal sey, “Make yu nor leave us wey bi yor savants! Make yu kom save us! Bikos all Amor pipol kings wey dey di kountries for hill don kom attack us.”
Joshua win di whole land plus di kountries for hill; di Negev; all di land for Goshen; di lowlands; di Arabah; di hill kountries for Israel and en lowlands,
En kingdom na: Arabah east, from Kinneret Sea go rish Arabah Sea (Di Salt Sea), plus di road wey go Bet-Jeshimot and di sout aria under di low aria for Pisgah.
Bet-Haram valley still dey join, plus Bet-Nimrah, Sukkot and Zafon go rish di rest side for Heshbon wey King Sihon dey rule; plus di aria for Jordan River east go rish di end for Kinneret Sea.
Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.