Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 11:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Joshua win di whole land plus di kountries for hill; di Negev; all di land for Goshen; di lowlands; di Arabah; di hill kountries for Israel and en lowlands,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 11:16
16 Iomraidhean Croise  

Doz wey nor know am, E give dia land to Israel en pipol and dem plok fruit wey odas plant.


E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.


and na on-top di mountin wey high pass for Israel. E go grow kon get branches; bear seed and e go bi very fine cedar. Difren birds go stay der kon build house put for di cedar tree.


“But trees go grow again on-top Israel mountins and dem go bear fruits for my pipol Israel and una go-go back to una own land.


So make una get up kon kontinue una journey go Amor kountries for di hill; all di arias wey dey near der, di high lands, di Shefelah, di Negev, all di lowland, Kanaan and Lebanon, still e rish di great River Eufrates.


Joshua win di whole land plus di kountries for hill, for di Negev, di lowland, di slope and all dia kings. E nor let any one live. E kill evritin wey dey breath, just as di Oga wey bi Israel God, tok.


Joshua win di aria wey dey between Kadesh Barnea and Gaza, plus evriwhere for Goshen go rish Gibeon.


God savant, Moses, tell Joshua evritin wey God kommand and Joshua do as Moses tell am. E nor go against any of di kommand wey God tell Moses.


and all di kings for nort wey dey rule di kountries for hill, di Arabah for di sout for Kinneret, di ones for di lowland and doz ones for Dor wey dey di west,


For dat time, Joshua attack and kill Anak pipol for di hill kountry, Hebron, Debir and Anab from all di hill kountry for Judah and Israel.


plus di kountries for hill, di lowlands, di Arabah, di low groun, di wildaness and di Negev; Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol land. Dis na di kings:


Wen all di kings for Jordan River west; di kountries for hill; di ones for di valley go rish Mediterranean wotaside; plus di whole Lebanon (plus Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol) hear about Israel pipol and wetin dem do,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan