7 So Joshua, en sojas and di ones wey get heart well-well kon from Gilgal mash go Gibeon.
“Make yu nor join di pipol plan and nor fear di tins wey dem dey fear.
Bikos I dey holy; I bi like stone wey dey fall pipol and rock wey dey make pipol stagga. Yes! I bi like trap wey go katch pipol for Jerusalem.
Di men for Gibeon kon send message go meet Joshua for en kamp for Gilgal sey, “Make yu nor leave us wey bi yor savants! Make yu kom save us! Bikos all Amor pipol kings wey dey di kountries for hill don kom attack us.”
God tell Joshua, “Make yu nor fear or bigin shake! Take all di sojas make una mash go Ai! Si, I dey give yu Ai king, plus di pipol and di town.
Joshua and all di sojas kon mash dey go Ai town. Joshua choose 30,000 strong sojas kon send dem go for nite.