Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”
Di men for Gibeon kon send message go meet Joshua for en kamp for Gilgal sey, “Make yu nor leave us wey bi yor savants! Make yu kom save us! Bikos all Amor pipol kings wey dey di kountries for hill don kom attack us.”
All di towns wey Filistia pipol don take from Israel before, Israel pipol kon take dem back from Ekron go rish Gat. Israel pipol take dia aria from Filistia pipol hand and peace kon dey between Israel and Amor pipol.