Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 10:41 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

41 Joshua win di aria wey dey between Kadesh Barnea and Gaza, plus evriwhere for Goshen go rish Gibeon.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 10:41
19 Iomraidhean Croise  

and dia land kon wide from Sidon to Gerar go rish Gaza and from der to Sodom, Gomorrah, Admah and Zeboiim till e rish Lasha.


One nite wen Solomon dey Gibeon town, God kon appear and ask am for dream sey, “Solomon, make yu ask mi for anytin wey yu wont and I go give yu.”


Ashkelon pipol go si all dis tins and fear go katch dem. Wen Gaza pipol go si dis tins, dem go bigin shake. Even Ekron pipol nor go get hope again. Dem go kill Gaza king kon distroy and skata Ashkelon town.


Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land.


Una papa do di same tin wen I send dem from Kadesh Barnea go si di land.


Den e go turn from sout go Akrabbim kon kontinue go Zin till e rish Kadesh Barnea. E go-go nort-west to Hazar Addar and Azmon,


God angel kon tell Filip, “Get up make yu waka for di wildaness road wey dem dey pass from Jerusalem go Gaza.”


Den just as God kommand us, wi komot from Mount Horeb kon travel pass di great wildaness wey dey make pesin fear, just as unasef go remember, den wi face Amor pipol kountries. Wen wi rish Kadesh Barnea,


But for Avvim pipol wey kom form Krete and dey stay di west side for Gaza and Kaftor pipol aria, make una distroy and take dia land.)


Den wen E send una from Kadesh Barnea kon sey, “Make una go take di land wey I don give una,” una still sin against di Oga una God, bikos una nor bilive or obey am.


Di day wey God put Amor pipol for Israel pipol hand, dat day Joshua pray to God for Israel pipol front sey: “Yu sun, make yu stay for where yu dey on-top Gibeon! And make di moon nor near dis side, just stay for where yu dey for Aijalon Valley!”


Evribody for Jerusalem dey fear, bikos Gibeon na big town, like one of di kings town. E big pass Ai and all en men dem get pawa.


Joshua win di whole land plus di kountries for hill; di Negev; all di land for Goshen; di lowlands; di Arabah; di hill kountries for Israel and en lowlands,


No Anak pesin remain among Israel pipol, but some dey for Gaza, Gat and Ashdod.


Goshen, Holon and Gilo and dem bi eleven big and small towns.


One day, Samson go Gaza wey bi Filistia pipol town and e stay der thru-out with one ashawo.


So Filistia pipol katch am kon blind en eye, den dem tie am with bronze shain; take am go Gaza kon force am make e dey grind korn for prison.


Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan