32 and God make dem win and dem enter di whole town for di sekond day. Dem kill evribody wey dey stay der, just as dem do for Libnah.
Like dis, Joshua win Amalek pipol and dia sojas.
Wen Assyria offisa oga kom back from Jerusalem kon hear sey di king don komot from Lakish go fight against Libnah town wey near dem, e kon go meet and tok to am for der.
Wen di Oga una God don give dis kountry to una and una don konker dem, una must distroy dem finish. Make una nor enter agriment with dem.
Dat day, Joshua enter Makkedah town kon kill evribody wey dey stay der plus di king. E do di king wetin e do to Jeriko king.
Joshua and en sojas kon mash from Libnah go Lakish. En and en sojas kon fight against Lakish
Den, Horam wey bi king for Geza kon kom help Lakish, but Joshua kill en and all en sojas finish.
Joshua enter all di royal towns kon kill dia kings, just as God savant, Moses kommand dem.