Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 10:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Evribody for Jerusalem dey fear, bikos Gibeon na big town, like one of di kings town. E big pass Ai and all en men dem get pawa.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 10:2
16 Iomraidhean Croise  

Joab still kontinue en fight against Rabbah wey bi di kapital town for Ammon and e don dey win am.


Raitious pipol dey get wetin dem wont, but wetin wiked pipol dey get, na di tin wey dem fear pass.


Nobody go fit stop una; di Oga una God go make dem fear una for any land wey una waka enter, just as E promise una.


From today, evribody wey dey di world, I go put fear for dia mind, bikos of una and even wen dem hear una name, fear go katch dem. Dem go fear nearly die wen dem hear sey una dey kom.”


Den evribody for di eart go si sey una bilong to God and dem go respet una.


But wetin wi go dey fear for na di Judgement Day wey dey kom and hell-fire wey go distroy doz wey bi God enemies.


Na big wahala if pesin fall enter God ponishment!


Dem tell Joshua, “True-true, God don really give us di land, bikos evribody wey dey stay di land dey fear us well-well!”


Dem kon tell Joshua, “Wi do like dis, bikos wi hear sey na really true sey di Oga una God don kommand Moses make e give una di whole land kon kill all di pipol wey dey stay der as una rish der. Wi do like dis, bikos wi dey fear una and wi nor won die.


Wen di pipol for Gibeon hear wetin Joshua do to Jeriko and Ai,


David tell Akish, “If yu know sey I bi yor friend, make yu give mi one small town make I stay. Wetin go make yor savant dey follow yu stay di royal town?”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan