David use di town pipol take work well-well with saw, iron hoes and axe, den e force dem make bricks. Na so e do give di pipol wey dey di oda towns for Ammon. Den en and en men kon go back to Jerusalem.
Di men for Gibeon kon send message go meet Joshua for en kamp for Gilgal sey, “Make yu nor leave us wey bi yor savants! Make yu kom save us! Bikos all Amor pipol kings wey dey di kountries for hill don kom attack us.”