14 Dat kind tin neva happen before and e nor happen again. God listin to one man, bikos E fight for en pipol, Israel!
God go fight for una, so make una nor worry.”
E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”
For di place wey Ahaz build, God go make di sun shadow go back ten times.” So di shadow kon go back ten times.
Den God go-go fight against doz nashons, just as E fight before.
Jesus ansa, “Even if una faith small like mustard seed, una go fit tell dis big tree sey, ‘Make yu komot from here go enter river’ and e go obey una.
Di Oga una God go first go fight for una, just as una si evritin wey E do for Egypt
Den Joshua and Israel sojas kon go back to di kamp for Gilgal.
Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.
Una si evritin wey di Oga una God do to di oda nashons and as E take fight for una.