Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 10:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 10:10
29 Iomraidhean Croise  

E shot en arrow take skata en enemies. E use strong lite take make dem run.


Solomon use en workers take ribuild am. Solomon still ribuild Lowa Bet-Horon;


God kon help Asa and Judah pipol and dem kill Kush sojas, while di remainin ones kon run.


Di pipol wey King Amazaya nor gri make dem follow am go fight kon go attack Judah towns wey dey near Samaria and Bet-Horon. Dem kill 3,000 men kon karry many of dia tins go.


E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash, dem kon dey konfuse more-more.


Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem.


Wen God wey get pawa skata kings, dem dey melt like snow for Mount Zalmon!


E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.


Den God go raiz-up as E do for Mount Perazim and for Gibeon Valley, so dat E go do wetin E won do. Even if wetin E dey do dey sopraiz us; E go komplete en wonderful work.


God go shaut well-well kon fight with pawa. Yes! E go vex kom with fire wey dey distroy, heavy rain and with big-big stone wey dey fall from heaven.


and dat time, Babilon king and en sojas dey attack di town. Di sojas still attack Lakish and Azeka, di only oda strong town wey remain for Judah.


Den God go-go fight against doz nashons, just as E fight before.


Di Oga una God go give dem to una; E go make dem fear well-well until una go distroy dem finish.


As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.


Dat day, Joshua enter Makkedah town kon kill evribody wey dey stay der plus di king. E do di king wetin e do to Jeriko king.


Joshua attack dem by sopraiz afta dem use one full nite mash kom from Gilgal.


God give dem to Israel and en pipol kill and porshu dem go rish Greata Sidon, Misrefot-Maim and Mizpa Valley for di east. Dem kill all of dem finish.


Makkedah king, Bethel king,


Jarmut, Adullam, Soko, Azeka,


Gederot, Bet-Dagon, Naamah and Makkedah and dem bi sixteen big and small towns.


E from der go di west side for Jafletite aria and di low arias for Bet-Horon and Geza kon end for di sea.


Di aria wey dem give Efraim and en family na: di east for Atarot-Addar go rish top of Bet-Horon.


Kibzaim and Bet-Horon, plus all di aria for der and dem bi four big towns.


Wen Barak attack, God kon konfuse Sisera and en men. Sisera kom down from en war horse kon take leg dey run.


But Barak porshu di war horse and Sisera men go Haroshet-Haggoyim kon kill all of dem for der.


From di sky, di stars dey move and fight against Sisera.


anoda group face di road wey go Bet-Horon and di last group kon dey waka go di road wey go di borda where dem for dey si Zeboim Valley for di desert side.


Filistia pipol gada dia sojas to go fight. Dem gada for Soko wey dey Judah. Dia kamp dey for Efes-Dammim wey dey between Sokoh and Azeka.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan