Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 1:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Just as wi obey Moses, na so wi go obey yu too. Make di Oga yor God dey with yu as E dey with Moses.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 1:17
19 Iomraidhean Croise  

“Oga, I tok to mysef sey yor promise go make mi dey save, bikos di king bi like God angel wey know good from bad. Make God wey bi yor God dey with yu!”


As Oga God don dey with awa king, make E dey with Solomon and make E prosper am, pass yu.”


David tell Solomon en pikin, “Make yu nor fear, but start di work with strong heart and nor let anytin stop yu. God wey I dey serve, go dey with yu. E nor go abandon yu, but E go stay with yu till yu finish di temple and evritin wey go dey inside.


Wen yu dey for trobol, make God ansa yor kry for help. Make Jakob God name, save yu from all wahala.


Make E do evritin wey yu wont and make yu prosper for evritin wey yu dey do.


God, make Yu give viktory to awa king kon ansa awa kry for help.


God ansa, “Make yu take Joshua wey Nun born kon put yor hand for en head, bikos na-im go fit lead dem;


Give am some of yor pawa, so dat all di kommunity go obey am.


Pipol wey dey go for Jesus front and dem wey dey follow am for back kon dey shaut, “Praiz David Pikin! Di pesin wey kom with God name, God go bless am! Make wi praiz God wey dey heaven!”


Naw, Nun pikin, Joshua get wisdom well-well, bikos Moses don pray for am. So Israel pipol dey obey Joshua and dey do God kommand wey E give dem thru Moses.


So dem ansa Joshua, “Wi go do evritin wey yu tok and wi go-go evriwhere wey yu send us go.


“Anybody wey won show sey e sturbon and e nor gri do wetin yu kommand, wi go kill-am. But make yu dey strong kon get heart!”


Nobody go fit stop yu still yu die. I go dey with yu as I dey with Moses. I nor go forget or leave yu.


I dey tok again, so dat yu go dey strong kon get heart! Make yu nor fear or shake, bikos mi wey bi di Oga yor God, I dey with yu for evritin wey yu dey do.”


Dat day, God give Joshua honor for Israel pipol front. Dem respet am till e die, just as dem bin respet Moses.


David still sey, “God wey diliver mi from di lion and di bear, go still diliver mi from dis Filistia man hand!” Den Saul kon tell David, “Make yu go fight am and make God dey with yu.”


But if really sey my papa get mind to kill yu, make God do all dis tin and many more to Jonatan if I nor kon tell yu, so dat yu go run go hide. Make God dey with yu, as E bin dey with my papa.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan