4 Den Oga God kon ansa Jonah, “Na wish rite yu get to dey vex?”
Den Oga God ask Kain, Wetin make yu dey vex and why yor face shange?
King Ahab kon dey vex and e nor happy with wetin Nabot tell am. E liedan face di wall for en bed and e nor gri chop.
Make yu dey kareful, so dat dem nor go fool yu with money or sey yu follow money go di wrong way.
Jonah nor happy bikos of wetin happen, so e kon dey vex.
So my God, make Yu just kill mi. E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”
So Jonah kon go sidan for di east side for di town. E arrange one small place for der kon sidan dey wait to si wetin go happen to di town.
But God tell am, “Wish rite yu get to dey vex bikos of di small plant?” Jonah ansa, “I get evry rite to vex till I die!”
My pipol, wetin I do una? Wetin I do wey make una taya for mi? Make una ansa mi naw!
“Aaron nor go enter di land wey I promise to give Israel pipol; e go die, bikos una nor gri obey my kommand for Meribah.
Abi I nor fit use wetin bi my own as I like? Or yu dey jealous bikos I dey do good tin?’