Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jonah 3:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 May bi God go shange en mind kon stop to vex for us, den wi nor go die again!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jonah 3:9
14 Iomraidhean Croise  

David ansa, “Yes! I kry and fast wen e still dey live. I tink sey God go forgive mi, so dat di pikin nor go die.


E remember en kovenant with dem kon sorry for dem, bikos of en love wey nor dey fail.


Yu nor dey vex for dem again and Yu nor show dem yor vexnashon.


My God, make Yu kom back to us! Na how long wi go dey sofa like dis? Make Yu kom sorry for yor savants!


Una must shange kon obey di Oga una God. Una must stop to live di bad life and wiked tins wey una dey do. If una stop am, God go shange en mind and E nor go distroy una.


So, my king! Make yu follow my advise. Make yu turn from sin kom meet God; dey do good and sorry for poor pipol. Den yu go kontinue to prosper.”


Make una hate bad tins kon love to do good, den dey judge well for kourt. May bi God go sorry for di pipol wey still remain for dis land.


So dem trow Jonah inside di wota, den di breeze kon stop.


Wen di kaptain for di ship si am, e kon wake and ask am, “How kom yu fit dey sleep for dis kind time? Make yu get up kon pray to yor God make E kom help us. May bi E go sorry for us kon save awa life.”


Den e kon dey komplain to God, “My God, before I komot from my kountry, I know sey dis na wetin Yu go do? Na dis tin make mi try to run go Tarshish! I know sey Yu dey sorry and kare for pipol and Yu get patient, dey kind and instead of Yu to ponish pipol, Yu always dey ready to forgive dem.


Una wey dey honbol, make una ask make God bless and help una to follow en kommand. Make una do wetin dey rite and live betta life. May bi God go protet and save una from en vexnashon, wen E won distroy di world.


Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan