My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.
Pipol wey don die, dey happy to welkom Babilon king. Pipol wey dey strong well-well wen dem dey life, dia ghost dey wait am and all di former kings ghost raiz from dia throne dey wait am too.
I go take am go where dead body dey. I go make una stay for dat undagroun wey empty and na dead body go bi una friend. Bikos of dis, una nor go ever kom out or stay with pipol wey dey alive again.
So from naw go, no matter how dem wota any tree rish, e nor go grow kon tall rish di kloud again. All of dem must die like man pikin, dem must die go where dead body dey.’ ”
David vex well-well, bikos en men dey tink for dia mind sey make dem stone am. Each man dey kry for en pikin. But di Oga God kon give David strong mind.